Cholera na one disis of belle wey one bateriha dey korse. Di nem of di bateriha na Vibrio cholerae. Pesin wey get cholera fit no show eni sahin sey e get am somtim. Di mejo sahin wey dey show sey pesin get Cholera na wen pesin dey shit wota-wota shit for som days. Pesin fit still dey vomit an e bodi fit dey strong eni-how. Bikos di pesin dey shit wota-wota shit, e go dey find wota to drink an e go don rilis plenti kemika wey dey helep di bodi to kontrol how wota dey enta an komot for bodi.

Bikos of sey plenti wota don komot for di bodi, di pesin faze fit big pass nomal, e bodi fit dey kool, e bodi fit no smooti an e leg an hand fit bi like sey e fold small. All dis sahin fit hapun bitwin two hours to five days wen kolera don enta di bodi. Na difren Cholera de bikos di vairus wey dey korse am difren from one anoda. Som vairus de bad pass one anoda an wetin pesin go dey see as sahin fit bad pass anoda. Di Cholera sahin dipen on di kind vairus wey enta di pesin bodi.