Chiwetalu Agu
Chiwetalu Agu (dem bon am for 1956) na Naija aktor . Na Agu win di 2012 Nollywood for Best Indigenous movies (fim wey dem no spik Inglish inside). E sabi yuz slang an oda forni wods an dis one mek Agu popula wel wel among pipo-dem wey like to dey luk Naija fims.
Wen profesor Femi Shaka of Yunivasiti of Pot Hakot dey tok abaut how komedi fit bi one metod wey fit helep mek pipo sabi Naija kolsho outside Naija, e meshon Chiwetalu Agu as one of di Naija aktor wey sabi do komedi.
Agu wife na Nkechi an na three boi an two gel-pikin e get.
How e tek wok
chenj-amAgu fest dey do Televishon show bifor e enta to dey do nolliwood fims. E don pass ova 30 years wey Naija pipo don dey sit-down dey luk fim for TV bifor dem even bon Nolliwood.
Chiwetalu Agu dey one of di fim-dem wey NTA (Naijiria Televishon Ortoriti Shanel 8 Enugu's dey show dat time. Di nem of di TV show na Ikoro an na Joe Onyekwelu produs am. Chiwetalu Agu still de ETV Shanel 50, wey leta chenj dia nem to ESBS. Di show we ETV Shanel 50 show for dia steshon wey Agu de inside na Baby come now an Ripple. Na Zeb wey bi Chico Ejiro broda produs Ripple. In di fim, na Agu do di pat of Shif Abunna.
Fim-dem wey e de inside
chenj-amWahala wey e don enta
chenj-amFor 7 October 2021, Souja harest Chiwetalu Agu for Iweka Bridge in Onitsha. E yuz slip inside dia steshon bifor di presidor of e organisashon Actors Guild of Nigeria kom komot am from di Hami steshon. Di risin wey mek souja harest am bi sey, e put on dress wey get Biafra flag as desin
Awod-dem an di one wey e no win
chenj-am- Wen Nollywood Movie Award stat dia awod in 2012, Agu nem dey di katigori of aktor wey fit win the best actor in indigenous movie for wetin e do in di fim kol Nkwocha
- Zulu African Film Academy Awards in 2011 put Agu nem in di katigori the best Supporting actor
- Wen Africa Movie Academy Awards dey do dia nomba 4 awod serimoni in 2008, dey put AGU nem for Best Actor in a supporting role katigori