Chido Obi
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Wen dem bon am29 November 2007 Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am

Chidozie Obi-Martin ( dem bon am 29 November 2007) wey pipo sabi wel wel as Chido Obi na one Denmark futbol playa wey dey play for Arsenal klub. Arsenal futbol klub de play Premier League in England. Na front im dey play for Arsenal.

How e tek start life chenj-am

Na for Glostrup wey de Copenhagen in Denmark dey bon Obi. Obi mama kom from Denmark but e papa kom from Naija.

How e tek play futbol chenj-am

Obi start to dey play futbol with one lokal klub wey di nem na Kjøbenhavns Boldklub. Kjøbenhavns Boldklub de Denmark. Obi kom komot from Denmark enta England wey e still bi smol pikin. E join Arsenal Akedemi wen e rish fourteen years. Wen e de di Akedemi, Obi show sey e sabi play futbol wel wel as e dey score goal wel wel . By di time wey Obi wan rish fifteen years, e don enta onda-18 side of di Akedemi. Di fest game wey Obi play for di onda-18 side, e score hat-trik (3 goals). Dat game na bitwin Arsenal onda-18 an Southanpton onda-18. Na 23 September 2023 dey play di game an di final score na 4:0. Afta di game, Denmark pipo kom dey kompiya Obi to Victor Osimhem In October 2023, Obi play e fest game for di onda-21 side wen e still bi fifteen years. Mikel Arteta wey bi di sinior tim manija kol Obi to kom dey train with dem in Eli November 2023. Nius-pepa kari wetin Obi do inside di game wey hapun bitwin onda-16 side of Arsenal an onda-16 side Liverpool. Na on di 18 November 2023 di game hapun. Inside dat game, Obi score ten goal out of di 14 goal wey Arsenal tim score dat day. Di final score na 14:3.

How e tek play for im kontri chenj-am

Obi fit play for three difren kontri: Denmark, England, an Nigeria. Obi play five game for Denmark onda-16 in 2022. E leta chenj kontri an play for England onda-16 side in February 2023. Obi stil leta go bak to Denmark onda-16 side go play for dem in April 2023. Inside di three game wey Obi play for onda-16 side, e score two time. Bikos Obi sabi score goal wel wel, di Denmark onda-17 side chuz am to bi part of dia tim wey play di 2024 UEFA European Under-17 Championship qualification. Out of di three fest game wey e play for dem, Obi score two goals.