Bimbo Oshin
Industry | film industry, cinema of Nigeria, entertainment industry |
---|---|
Man abi wuman | wuman |
Kontri wey e kom from | Naija |
Nem for lokal langwej | Bimbo Oshin |
Orijina nem | Bimbo Oshin |
Fest nem | Abimbola |
Famili nem | Oshin |
Wen dem bon am | 1971 |
Ples wey dem bon am | Ondo State |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
Wok wey e dey du | actor, film director |
Pat of wok wey e put mind | theater arts |
Wie e go skul | University of Lagos |
Academic degree | Bachelor of Arts |
Wen e stat wok | 1996 |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Filmography | The New Patriots, Omo Elemosho |
Notable work | Omo Elemosho |
Nominated for | Africa Movie Academy Awards, City People Entertainment Awards |
Personal pronoun | L484, L305214 |
Abimbola Oshin (dem bon am on 24 July 1971) na aktres, raita, produsa an bizneswuman for Naija.
How shi tek stat life
chenj-amDem bon Oshin on 24 July 1971 insaid Ondo Stet Sautwestern Nigeria. Shi dey insaid one of Pa Olasanmi Theophilus Oshin's 8 pikin. Oshin go Universiti of Legos wia shi tek get Bachelor of Arts (B.A.) digre in Philosophy. Oshin stat to dey akt in 1996 but plenti pipu sabi am wen shi du Elemosho, wey bi Yoruba fim in 2012.
Oshin gro for Ondo Stet wia shi tek du primari edukeshon for Saint Anne's Primari Skul, shi leta go Staff Primari Skul, Ile Ife, Osun Stet. For sekondri edukeshon, shi go Girls Academy, Sandgrouse wey dey Legos Stet. Osun go Universiti of Legos, wia shi tek kolet Bachelor of Arts (B.A) digre in Philosophy.
Wok
chenj-amOshin's stat to dey akt wen shi smol, shi dey du som video for hause wit im sista. But shi stat wok as aktres onda Ara Osan Grup, wen shi dey Universiti of Legos. Na English fim shi fest du but leta na Yoruba fim dem tek sabi am wel wel. Di fest fim shi tek popula wel wel for Nollywood na Akobi wey dem du insaid 1997.
Som wok wey shi du
chenj-am- Eji Owuro (2003)
- Civil War (2003)
- Omo Oku Oron (2004) as Salewa
- Ota (2007)
- Igi ola mi (2008) as Laide
- Omo Elemosho (2012) as Biola
- Kakanfo (2020) as Yeye
- The New Patriots (2020) as Princess Gladys Olubo
- May 29 (2020) as Mummy Mayowa
- Abebi (2021) as Bolade
- Alimi (2021) as Ronke
- Strangers (2022) as Toyin
- A Bag of Trouble (2023)
Awoda
chenj-amIn 2016, shi kolet Icon Category Award insaid di 2016 Afro-Heritage Broadcasting an Entertainment Awods.[1]
Year | Awod ceremony | Prize | Result | Ref |
---|---|---|---|---|
2014 | Yoruba Movies Academy Awards | Best Actress in a Leading Role | Nominated | [2] |
City People Entertainment Awards | Best Actress of the Year (Yoruba) | Nominated | [3] | |
2015 | ZAFAA African Film Academy Awards | Best Female Indigenous Actor | Nominated | [4] |
Wia dem gada tori
chenj-am- ↑ "AHBEA 2016 Nominee, Bimbo Oshin, Icon Award Category". naijaonlinetv.co.uk. 9 July 2016. Retrieved 16 February 2017.
- ↑ Orenuga, Adenike (31 March 2014). "Yoruba Movie Awards: Odunlade Adekola, Fathia Balogun, others win [See full list of winners]". Daily Post. Retrieved 16 February 2017.
- ↑ Izuzu, Chidumga (9 June 2014). "Meet The Nominees: Nominees for City People Entertainment Awards". pulse.ng. Archived from the original on 16 February 2017. Retrieved 16 February 2017.
- ↑ Izuzu, Chidumga (3 November 2015). "Queen Nwokoye: Actress wins 'Best Actor Indigenous Female' at ZAFAA 2015". pulse.ng. Archived from the original on 24 June 2016. Retrieved 16 February 2017.