Augustine Eguavoen

Augustine Eguavoen
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Country for sportNaija Chenj-am
Fest nemAugustine Chenj-am
Wen dem bon am19 August 1965 Chenj-am
Ples wey dem bon amBenin City Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player, association football manager Chenj-am
Position played on team / specialitydefender Chenj-am
Wen e stat wok1985 Chenj-am
Work period (end)2001 Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am

Augustine Owen Eguavoen (dem bon am 19 August 1965) na Naija futbol manija an bifor bifor pleya wey don play for Naija nashonal tim. Eguavoen don kosh di Naija nashonal tim for three difren times.

How e tek play futbol

chenj-am

Eguavoen fest klub na ACB klub wey de Legos Stet an na difenda bi e posishon.

Bikos of sey Eguavoen sabi play wel wel, Gent futbol klub sahin am in 1986 to play for dem Oda klub dem wey Eguavoen play for na: K.V Kortrijk, CD Ourense, Sacramento Scorpions, Torpedo Moscow. Na for Sliema Wanderer Eguavoen finish e Karie as a futbola.

How e tek play for im kontri

chenj-am

Eguavoen de di Naija futbol Tim wey kwulify Nigeria for dia fest World Cup kopetishon in 1994. Eguavoen folo join for di tim wey win di 1994 Cup of Neshon in 1994.

How e tek kosh futbol tim

chenj-am
  • Sliema Wanderers

Na for dis klub Eguavoen start to dey do koshin for klub. Sliema Wanderers hagri mek In 1999-2000, di klub hagri mek Eguavoen dey play for dia klub an stil dey kosh dem. Eguavoen do dis one for some month, but e leta komot dia in 2000-2001 sisin

Naija hagri mek Eguavoen dey kosh di nashonal tim on June 2005. Pipo wey folo am dat time na: Daniel Amokachi, Samson Siasa, an Ike Shorunmu. Eguavoen kari di nashonal tim go play Africa Neshon kup in 2006. Na Egypt dem tek play di kopetishon. Na Naija nashonal tim kari di nomba three posishon for di tonamet.

Dem komot Eguavoen as kosh of Naija tim in April 2006.

  • Black Leopards

In March 2008, Eguavoen kosh di South Africa futbol klub Black Leopards

  • Enyimba International

Dorin di 2008-2009 futbol sisin, Eguavoen bi di kosh of Enyimba International wey de Aba in Naija. Wen e bi di kosh, Eguavoen kari di tim rish nomba 3 posishon for Naija ligi an e helep Enyimba to win di Fedireshon Kup

  • Ritorn to Naija

In June 2010, Naija Futbol Fedireshon kol Eguavoen to riples Lars Lagerback . Eguavoen dey wok as kia-teka wen Lar Lagerback no de di work. In August 2010, Eguavoen bikom di kosh of Onda-23 futbol tim. Wen John Obuh wey bi kosh of Sharks F.C bikom di kosh of Naija Onda-20 futbol tim, Sharks F.C pik Eguavoen to riples John Obuh as di kosh of di klub. Dis one hapun on 27 October 2012 Wen Shark F.C don play seven game an di tim stil de down down for Naija futbol ligi tebu, Eguavoen ri-sain as dia kosh. For April 2013, Eguavoen sain to bikom di niu kosh of Naija Nashonal Ligi Side COD United.