Asamoah Gyan
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Gana |
Nem for lokal langwej | Asamoah Gyan |
Fest nem | Asamoah |
Famili nem | Gyan |
Wen dem bon am | 22 November 1985 |
Ples wey dem bon am | Accra |
Broda an sista | Baffour Gyan |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Ga, Twi, Ghanaian Pidgin English |
Wok wey e dey du | association football player |
Position played on team / speciality | forward |
Wie e go skul | Accra Academy |
Wen e stat wok | 2003 |
Work period (end) | 20 June 2023 |
Sport | association football |
Sport number | 35 |
League or competition | Premier League |
Asamoah Gyan (Dem bon am on 22 November 1985) na Ghanian forma futbola wey pley as strika. Na im bi di forma captain for Ghana nashonal teem.
Gyan stat to dey pley in 2003 wit Ghana Premier League Klub Liberty profeshonal wia e store ten goals insaid sixteen match e kon uze three season wit Seria A Klub Udinese fom two season loan for Modena e skore fifteen taims insaid 53 league match an wen e dey Udinese e skore 11 taims insaid 39 league match. In 2008, Gyan go Ligue 1 klub Rennes. e skore fourteen taims insaid 48 league match for two seasons.
Insaid 2011, Gyan go Al Ain of di UAE pro League for loan an na im kon bi di pesin wey skore pas for di league, e skore 22 taims insaid 18 matches wey e pley. Di season wey folo, Gyan go Al Ain pamanet an hep dem win di Pro League, na im stil bi di pesin wey skore pas for di league, e skore 31 goals insaid 22 matches. In di 2014 - 14 league season, na Gyan bi di pesin wey skore pas for di league wey mek am di third taim, wit 29 goals insaid 26 matches.
Na Gyan skore pas for Ghana nashonal teem, e get 51 goals. E dey insaid playa wey pley for Ghana insaid 2006, 2010 an 2014 FIFA Wod Kups. Wit 6 goals, na im bi di Afrika playa wey skore pas for Wod Kup. Gyan don pley for Ghana insaid di 2014 summer Olympics an insaid seven Afrika Kup of Nashons in 2008, 2010, 2012, 2013, 2015, 2017 an 2019, e hep dem kom third - ples in 2008 an sekond in 2010 an 2015. Na on 20 June 2023 Gyan tel Poblik sey e no wan stop to dey pley aktiv futbol.
Im Pasonal life
chenj-amNa Gyan bi di las bon for im papa an mama, Baffour Gyan Mensah (papa), an im mama wey don kpai Cecilia Amaoko. Im sinior broda, Baffour Gan sef dey pley futbol. Gyan Mari Gifty Gyan an dia two bon three pikin, wey dia nem na, Rafael Gyan, Fedrick Gyan an Floyd Gyan.
Tins e lik Apat futbol
chenj-amBoxing
In June 2012, Gyan stat to dey wan let pipu no sey Ghana get ogbonge boxer an sey e go dey sponsor boxing sho for Ghana.
Insaid February 2021, kontrat wey Bay Jet promotions du wit Emmanuel Tahoe no go wel. Di kontrat sopos stat on October 2018 an end November 2021.
Baby Jet Airline
For October 2017, dem giv Asamoah Gyan Air Carrier license (ACL) na Ghanian Civil Aviation Authority (GCAA) giv am.
Tennis
E stat to dey pley Table tennis in 2020 web e get injury. Baby Jet promotions an MACWA Commodities du tournament for hep Di sport gro.
Hau e tek wok for teble
chenj-amClub | Season | League | National Cup | League Cup | Continental | Other | Total | ||||||||
---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|
Division | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | |||
Liberty Professionals | 2003 | Ghana Premier League | 16 | 10 | – | – | – | – | 16 | 10 | |||||
Udinese | 2003–04 | Serie A | 1 | 0 | 0 | 0 | – | – | – | 1 | 0 | ||||
2006–07 | Serie A | 25 | 8 | 1 | 0 | – | – | – | 26 | 8 | |||||
2007–08 | Serie A | 13 | 3 | 0 | 0 | – | – | – | 13 | 3 | |||||
Total | 39 | 11 | 1 | 0 | 1 | 0 | 1 | 0 | 0 | 0 | 40 | 11 | |||
Modena (loan) | 2004–05 | Serie B | 28 | 7 | 0 | 0 | – | – | – | 28 | 7 | ||||
2005–06 | Serie B | 25 | 8 | 1 | 0 | – | – | – | 26 | 8 | |||||
Total | 53 | 15 | 1 | 0 | 0 | 0 | 1 | 0 | 0 | 0 | 54 | 15 | |||
Rennes | 2008–09 | Ligue 1 | 16 | 1 | 2 | 0 | 1 | 0 | Appearance in UEFA Cup | 0 | – | 20 | 1 | ||
2009–10 | Ligue 1 | 29 | 13 | 1 | 0 | 0 | 0 | – | – | 30 | 13 | ||||
2010–11 | Ligue 1 | 3 | 0 | 0 | 0 | 0 | 0 | – | – | 3 | 0 | ||||
Total | 48 | 14 | 3 | 0 | 1 | 0 | 1 | 0 | 0 | 0 | 53 | 14 | |||
Sunderland | 2010–11 | Premier League | 31 | 10 | 1 | 0 | 1 | 1 | – | – | 33 | 11 | |||
2011–12 | Premier League | 3 | 0 | 0 | 0 | 1 | 0 | – | – | 4 | 0 | ||||
Total | 34 | 10 | 1 | 0 | 2 | 1 | 0 | 0 | 0 | 0 | 37 | 11 | |||
Al Ain (loan) | 2011–12 | UAE Pro League | 18 | 22 | 1 | 2 | 5 | 3 | — | 0 | 0 | 24 | 27 | ||
Al Ain | 2012–13 | UAE Pro League | 22 | 31 | 2 | 0 | 0 | 0 | Appearances in AFC Champions League}} | 1 | 1 | Appearance in [[UAE Super Cup]} | 0 | 29 | 32 |
2013–14 | UAE Pro League | 26 | 29 | 4 | 6 | 2 | 0 | 12 | 12 | 0 | 45 | 47 | |||
2014–15 | UAE Pro League | 17 | 13 | 1 | 4 | 0 | 0 | 6 | 5 | 1 | 0 | 25 | 22 | ||
Total | 83 | 95 | 8 | 12 | 7 | 3 | 22 | 18 | 3 | 0 | 123 | 128 | |||
Shanghai SIPG | 2015 | Chinese Super League | 10 | 4 | 1 | 1 | – | – | – | 11 | 5 | ||||
2016 | Chinese Super League | 10 | 3 | 1 | 0 | – | 0 | – | 15 | 3 | |||||
Total | 20 | 7 | 2 | 1 | 0 | 0 | 4 | 0 | 0 | 0 | 26 | 8 | |||
Shabab Al-Ahli (loan) | 2016–17 | UAE Pro League | 14 | 6 | 1 | 0 | 3 | 3 | 7 | 2 | 1 | 0 | 26 | 11 | |
Kayserispor | 2017–18 | Süper Lig | 12 | 1 | 5 | 3 | – | – | – | 17 | 4 | ||||
2018–19 | Süper Lig | 14 | 4 | 3 | 1 | – | – | – | 17 | 5 | |||||
Total | 26 | 5 | 8 | 4 | 0 | 0 | 0 | 0 | 0 | 0 | 34 | 9 | |||
NorthEast United | 2019–20 | Indian Super League | 8 | 4 | – | – | – | – | 8 | 4 | |||||
Legon Cities | 2020–21 | Ghana Premier League | 6 | 0 | 1 | 0 | – | – | – | 7 | 0 | ||||
Career total | 347 | 177 | 26 | 17 | 13 | 7 | 34 | 20 | 4 | 0 | 424 | 221 |
Wia dem gada di tori
chenj-am1. Asamoa-Gyan quits Blackstars..www.graphic.com.gh. 20 May 2019. Retrived August 28 2023.