Asake
Ahmed Ololade (dem bon am January 13, 1995) wey pipo sabi wel wel as Asake na Naija Afrobeat singa an song raita. Asake de onda YBNL Nation an Empire Distribution rekod lebel kompini. Di nem Asake wey meni pipo tek no am bi di nem of e mama.
For February 3, 2023, Asake, Kiss Daniel, Snazzy the Optimist, an Lucid bi di nem-dem wey pipo chek dia muzik pass as singa akordin to Audiomack.
How e tek wok
chenj-amAsake rid akt for Obafemi Awolowo Yunivasiti wey de Naija. E stat to dey rilis muzik in 2008. Na di muzik "Mr Money" mek am blow wel wel. Leta, Asake kom du di remix of "Mr Money" an Zlatan an Peruzzi folo sing for di remix. For February 2022, Naija singa Olamide sahin Asake to e rekod lebel YBNL Records. For dat February, Asake rilis e fest habom Ololade an inside dat habom di muzik wey mek am popula wel wel "Omo ope de inside. Olamide join sing inside "Omo Ope". Anoda song wey de inside di habom na "Sungba". Asake du di remix of "Sungba" one month leta an e kol Burna boy to join sing inside. Asake in July 2022 sahin wit Empire rekod sey mek dem helep am dey sel e habom.
Na on September 8, 2022 Asake rilis e fest studio habom Mr Money and the Vibe, Seven month afta wey e don rilis e habom EP. Di habom get hit singu like "Terminator", "Peace be unto you" an di "Sungba" remix wit Burna boy. Meni pipo for Naija an overseas like di habom wel wel as di break meni rekod for di wold. Leta for di year, Asake stat e program to go around di wold to sing an e sel tiket three times sey e go sing for 02 Academy Brixton wey de London. For September 2022, Asake Tom sey e go sing "Mr. Money with the Vibe"' in UK.
Wen last day wey Asake wan finish e show for 02 Brixton Academy, meni pipo get injuri bikos of rush rush wey dem dey di dat day. Dis rush rush kill two pipo; 33 year old Rebecca Ikumelo an di 22 year old Sekwuriti man Gaby Hutchinson.
Asake win di Male MVP awod at di Soundcity MVP Awod wey dem du for Eko Convenshon Senta in Legos on February 2023. For April 2023, Asake tok for Good Morin Amerika show to diskuss e Muzik.
Some pipo tok sey Asake dey yuz Fuji dey sing e muzik bikos of sey e dey yuz Yoruba an some slang for e song.
Awod-dem wey e don kolet
chenj-amAsake win di "Best African Artist of the Year" for di Vodafone Ghana Music Awod .
Im wok
chenj-amStudio Album
Title | Album details | Peak chart positions | |||
---|---|---|---|---|---|
Top 50 Nigeria | Irish Album Charts | UK Albums Chart United Kingdom | Billboard 200 United States | ||
Mr Money with the Vibe |
|
1 | — | 22 | 66 |
Work of Art |
|
1 | 59 | 20 | 66 |
Extended plays
chenj-amTitle | EP details |
---|---|
Ololade |
|
Singles
As lead artist
chenj-amYear | Song | Peak chart positions | Ref. |
---|---|---|---|
2022 | "Sungba Remix" featuring Burna Boy | No. 7 US Afrobeats Songs | |
2022 | "Peace Be Unto You" | No. 1 Nigeria (TurnTable) No. 7 US Afrobeats Songs | |
2022 | "Terminator" | No. 82 UK Charts, | |
2022 | "Trabaye" featuring Olamide | ||
2023 | "Yoga" | ||
2023 | "2:30" | ||
2023 | "Amapiano" featuring Olamide |
As featured artist
chenj-amYear | Song | Peak chart position | Ref. |
---|---|---|---|
2022 | "Pallazo" by DJ Spinall | No. 6 US Afrobeats Songs | |
2022 | "Bandana" by Fireboy DML | No. 8 US Afrobeats Songs | |
2022 | "Loaded" by Tiwa Savage | ||
2023 | "No Competition" by Davido | ||
2023 | "New Religion" by Olamide | date=June 2023 |
Music videos
chenj-amTitle | Year | Director(s) |
---|---|---|
(Asake featuring Olamide | 2022 | TG Omori |
"Sungba" (Asake) | TG Omori | |
"Sungba Remix" (Asake featuring Burna Boy) | TG Omori | |
(DJ Spinall featuring Asake) | TG Omor | |
(Asake) | TG Omori | |
(Asake) | TG Omori | |
(Asake) | TG Omori | |
(Tiwa Savage featuring Asake) | TG Omori | |
(Asake) | TG Omori | |
"Yoga" | 2023 | TG Omori |
"2:30" | Joshua Valle & Edgar Esteves | |
(Asake featuring Olamide) | Jyde Ajala | |
"Basquiat" | Joshua Valle & Edgar Esteves | |
“Remember” |