Aminu Bello Masari

Aminu Bello Masari (dem bon am for May 29, 1950) na Naija politishan an na e bi di gofnor of Kastina Stet. Na Aminu Bello Masari bi komisiona for wok, haus an traspot for 1991 to rish 1993. Na Masari bi di bifor bifor Spika of Naijá haus of Rep for 2003 an 2007. Masari kom fom Masari vilej of Kafur Lokal Govment, Katsina Stet.

Aminu B Masari

How e tek du politis chenj-am

Masari kolet tiket wan bi govno of Katsina Stet for di 2011 eleshion onda Congress for Progressive Change (CPC) parti bot e no win di eleshon an na PDP kandidet wey bi Ibrahim Shehu Shema win am.

For December 2014, na Masari bi di kandidet wey All Progressives Congress chuz as dia Govno kandidet for di March 2015 eleshon.

Na im kon win for di April 11, 2015 for di Katsina Stet gofnor eleshon, im win Musa Nashina an Dr Dikko Umar Radda.

Aminu Massari enta ofis as gofnor of Katsina Stet on 29 May 2015.

Wen Masari enta ofis im kari di bifor gofnor Barista Shetima go EFCC bikos Masari tok sey Shetima don pak all di moni for Katsina Stet. Economic and Financial Crime Commission (EfCC) kon kari Shetima go kot. Gofnor Masari komot all lokal govment chairman wey kom fom anoda parti.

Aminu Bello Masari enta for sekond taim as gofnor of Katsina Stet for March 9, 2019 onda All Progressives Congress (APC) Masari get 1,178,864 vote for di Kastina Stet Govno Eleshon.

Wie dem gada di tori chenj-am