Akenzua II
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am1899 Chenj-am
Wen e kpai1978 Chenj-am
PapaEweka II Chenj-am
PikinErediauwa, Princess Elizabeth Olowu Chenj-am
Post wey e deyOba of Benin Chenj-am

Omo n'Oba n'Edo Uku Akpolokpolo, Akenzua II (January 7, 1899 – June 11, 1978) na Oba of Benin (di pesin wey dey rule di pipul wey kom from Edo for inside Naija) from 1933 to when e kom kpai for 1978.

Dem make Akenzua II di Oba of Benin for April 1933 afta im papa wey bi Ewekw II don kpai (r.1914-1933) for February dat year. Oba Akenzua II rili mek sure sey di Edo pipul go skul wel wel.

For 1936, e stat to dey among di pipul wey dey try mek dem riton di Bronze wey dey for Benin wey dem tif from di king haus an di ples wey dem tek dey serve dia gods bak to Naija wey hapun for di time wey dem atak di Benin pipul for 1897. Wen e stil bi di king, na onli two of di 3,000 royal court bronze dem riton bak to Naija. But dem riton two coral crown and coral bead garment wey dem biliv sey na Ovonramwen get dem an dem riton dem for di end of 1930. Di man wey riton dem na G.M. Miller an im papa folo pak dem di Benin propati an kom kari dem borrow di British Museum for 1935.

Oba Akenzua II kpai for June 11 1978 an im pikin wey dem dey kol Prince Solomon dat time kom tek ova. E kom chenj im title to Oba Erediauwa an kom bigin dey rule di Edo pipul wey dey inside Naija.

E famili chenj-am

E born im first pikin wey bi boi wey dem dey kol Prince Solomon Aiseokhuoba Igbinoghodua Akenzua for 1923. Di title wey e choose for imself na Ere, dem say d title na from one bifo bifo king wey dem dey kol Eresonye an pipul tok sey na king wey get moni an propati wel wel.

Na Princess Elizabeth Olowu bi Akenzua gel-pikin, na Peju Layiwola bi di gel wey im pikin bon an na Thompson bi di boi wey im pikin born.

Wie dem gada di tori chenj-am