Adamu Ncahama Baba-Kutigi

Naijá profesor
Adamu Ncahama Baba-Kutigi
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Wen dem bon am10 June 1956 Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am

Adamu Ncahama Baba-Kutigi (Dem bon am for June 10, 1956) na Naijá profesor an bifor bifor aktin Vice Chancellor for di Federal Univasiti of Dutsinma.Na for inside Kutigi for Lavun loka govament inside Naija Stet dey tek bon am.

How e tek stat life chenj-am

Dem bon Baba-Kutigi for June 10, 1956. E du e sekondiri skul for Government Secondary School Eyagi, Bida wey dey for Naijá Stet. Adamu bin kolet one satifiket for 1979 wey bi Nigerian Certificate in Education(NCE) fom Teachers Training College Minna wey dem don dey kol College of Education Minna. E go University of Sokoto wey dem don dey kol Usman Danfodio University. Na dia e get Bachelor of science degree for Physics. E leta du e masta an Ph.D for Physics fom ABU Zaria. Adamu get esperiens for tishin an risahi, an e dey di Student Teachers Association of Nigeria (STAN) grup.Adamu stil dey di Nigeria Institute of Physics (NIP) grup, e dey di Nigeria Association of Teachers Technology (NATT) grup. Adamu don before bi di Deputi-Dareto Center for Preliminary and Extra Moral Studies an stil bi memba of di Governing Council wey dey repiset di congregation for Federal University of Technology, Minna.

E life as Vice Chancellor chenj-am

Di pipul wey dem dey kol di Governing Council of di Federal University Dutsinma, Katsina mek di Professor Adamu Nchama Baba-Kutigi di niu Aktin Vice-Chancellor of di univasiti. Di senate of di univasiti nominate am for di 73rd emergency mitin wey dem du for March 2019. Bifor dem giv am dat posishion, Prof. Nchama Baba-Kutigi bi di forma Dean of di Faculty of Science an e bi di forma Head of Department of Physics for di univasiti.

Wie dem gada di tori chenj-am