Èkìtì chenj-am

Èkìtì nah one of the state for Southwest for Naija, wey get boda with Kwara North and Kogi Northeast, wey come reach Ondo South and Southeast, and come reach for de West of Osun State. Nah Yorùbá pipu dominate de area pass-nah de yhear 1996, Major General Sanni Abacha comot am make e no bi part of Ondo State for Naija; hin capital nah Ado Èkìtì. Èkìtì nah one of de state wey small pass for Naija, Èkìtì nah de 31st wey big pass for area and hìn come bí 30th wey get pipu wey reach 3.3 million for yhear 2016.

Geography chenj-am

Geographically De state dey divided among Naija lowland forest and de dry Guinea forest-savanna mosaic for de North. Among the natural things nah false acreas, mona monkey, forest buffalo, come join with grey parrot dem, with de Naija-Cameroon chimpanzee wey remain,come join am bi troop wey reach 20 chimpanzee wey dem life no dey save for de Ise forest wey dey for animals to dey stay. De Èkìtì state wey we get now bi de one wey hin pipu don dey stay for many many yhears,de pipu wey bi Yorùbá subgroup, wey bi small number of Akoko Yorùbá subgroup.

Religion chenj-am

Plenty pipu for de state (~85%) bi Christian, wey small number of pipu bi Muslim, come join nah very small pipu wey bi dey practice traditionalist wey bi 10% and 5%.