Kateryna Anatoliivna Pavlenko (dey bon am August 10, 1988) na Ukraine singa, komposa an na pesin wey de stodis an rekod how dem dey du tins for lokal way. Pipul sabi am wel wel as Monokate. Na Pavlenko bi di lid singa of di Ukraine folk band Go_A. Na Go_A band repriset Ukraine at di Eurovision Song Contest 2020 wit di song "Solovey". Wen dey kansu di program bikos of COVID-19 Pandemic, di band repriset Ukraine again in 2021 wit di song Shum.

How e tek stat life

chenj-am

Na August 10, 1988 dey bon Pavlenko Nizhyn, Chernihiv Oblast, in Ukraine. ( at dat time di nem of Ukraine na Ukraine SSR). Chernihiv Oblast na one siti wey de North-East side of Kyiv, di kapital of Ukraine. Pavlenko mama dey wok for di militri an dey no de give am eni mini for di wok dia. Dis one mins sey Pavlenko famili poor no bi smol an for sometime dey no even get ples to stey. Pavlenko gro up lisinin to tradishonal muzik. E gra-ma na singa an e tish Pavlenko how to sing tradishonal mizik. Di metod wey e gra-ma tish am na White Vois. Pavlenko gra-pa sabi play one muzikal instrumet kol Accordion. Pavlenko mama sef dey sing inside one tradishonal song muzikal band.

Wen Pavlenko still dey skul, e go rid muzik an e tisha-dem wan mek e bi singa wey go dey sing for stage lol "opera" singa. In Pavlenko mind, na singa wey de sing muzik wey di muzik dey loud e wan dey sing. Bikos of dis one, Pavlenko join one lokal rock band an wen e gro up smol an e pafom for meni show.

How e tek go skul

chenj-am

Pavlenko go Nizhyn Skul of Kolsho an Ant an e finish di soul in 2009. E kom enta Kyiv Nashonal Yunivasiti of Kolsho an Akts go rid Folklore an e finish in 2013.

How e tek wok

chenj-am

Pavlenko don hep daret meni group wey dey pafom. E don hep daret di popular band wey de araund Berezan, Kyiv Oblast. Pavlenko is di lid singa of di band Go_A an e don rait an poblish e own muzik onda one fake nem wey Hi Monokate.